
Thunder Wey Tie Wrapper: Funmilayo and di Abeokuta Soro Soke Uprising
Na Dis Book You Gats Read!
Wetin go make thunder tie wrapper? Na craze? Na magic? Abeg, no be all thunder dey strike — some dey wear gele and hold megaphone!
Make I yarn you small, dis no be your regular history gist. Thunder Wey Tie Wrapper na correct, gbas gbos, full-voltage tori of one Madam wey no dey use nonsense hear word — Funmilayo Ransome-Kuti — aka di original "No-Nonsense Mama" for Abeokuta!
Dis woman no just sabi English, she sabi slap oppression join. Wen di Alake and colonial people wan dey use women head do groundnut, Funmilayo gather women like pepper soup spice — dem march, dem protest, dem shout Sòrò Sókè! bifor soro soke even bikom Twitter trend.
Dis ebook go make you laugh, shout “Ehen?!", nod ya head like say na music dey play, and even vex small — but last last, e go ginger your swagger and make you proud say real women don dey scatter ground since 1920s!
Why you gats grab dis ebook sharp sharp?
Na Pidgin English wey sweet like puff-puff
You go learn, laugh and even wan dey form activist small
E go open your eye to how women wey wear wrapper take shake throne
Na correct ginger tonic if you dey dull
No go dull yaself. If you wan sabi how one woman become thunder wey tie wrapper and take shake colonial table till e break — download dis ebook now-now bifor thunder (and wrapper) go begin strike again.
We fit connect here:
Phone Number (WhatsApp): +2348139000453
Email: [email protected]
